FROM MAX UPNORTH TO INSIDE NEW TRAFFORD.
Maximus of Okada weekly, Episode 6.

Wetin Dey Happen, All my Naija pipo! How una dey? Na your boy Maximus Ogeneochuko. Hope una dey gallant for una Christmas preparation so? I don come to knack una better tori wey happen for the week.
I go start with good news, make I tortori una bodi. Our MAX movie wey be Up North been premiere on Sunday. We wey follow inside the movie start with grand durbar street parade for Saturday. If you see warrior horsemen, pipo wey dey dance, even me and some other Max champions follow dey with our bikes inside. The Sunday for movie so, na him we come waka for blue carpet, plenty celebrity show up oh; Ebuka, Banky, Rahama. Even Goffnor of Bauchi sef show with Emirs from Misau and Ningi. Me sef wey be Max, I show with Oga Nedu and Ized. The feem sef make sense die and go dey show for seenima from next Friday 28th Dec. See ehn? the gist no finish here, see pishurs wey we take for the whole tin for here.
Still on Entertainment, una hear say Offset wey be America rapper carry cake and flower go meet Cardi B for stage wen she dey sing? The tin funny and e no funny. The two of dem been dey get problem like that. Na him Offset begin beg Cardi make dem settle. Na her hand e dey sha.
I hear rumour say America don ban Runtown make e no come their country again. This one no good at all if na true. Runtown na one of our star boy, and I go dey clarify the tori wen e set wella.
Make we speed into politics small. Oga Presido on Wednesday, been table how much him wan spend for the country next year to national assembly pipo. Some lawmakers been dey shout for am, while others dey hail am. My own be say, make the money wey dem release, make dem use am do wetin dem say dem go use am do.
One of our former Oga wey dey command all the army pipo combine, Oga Alex Badeh don die. I hear say some bad bad pipo shoot am as him dey come back from him farm. We say make Oga Badeh rest in peace and make God for give him family mind.
For Wednesday, I dey office one of our Max champions call say fire dey burn for Abule-Egba. E come be say pipo wey go spoil pipeline dey pack petrol na him cause the fire. Plenty pipo die and property loss. Chai. I say sorry to everybody wey the thing affect. Abeg my pipo, make we no dey use all this petrol things dey play. No break pipe. If you see somtin, run call goffment pipo wey dey handle am. I use God beg una.
Last weekend, as I enter Yaba with my bike I see some women dey protest. Dem say dem dey do market march to tell everybody say dem no like as traders dey touch dem anyhow when dem show for market to buy market. Me wey be Max sef follow chook mouth, make we dey respect our women dem. No dey touch dem anyhow or no dey cuss dem with bad mouth because dem no buy your market. If we respect our women well, sexual harassment e go stop.
Inside another type of market, Access Bank don buy Diamond bank. The two banks join body to become one. E mean say all diamond customers dem go become Access bank customers. Dem don talk say make pipo no fear, na to make the banks dem strong kakaraka.
Our Ogas wey dey manage road dey make all of us dey safe, FRSC pipo don talk say dem don begin campaign to stop selling of alcohol for inside motopak. Dem say this one go reduce make drivers no dey carry highness enter steering, and if e happen so, accident go reduce for we road. Me sef, I support this one.
Manchester United don sack their coach Oga Mourinho. Mourinho wey been dey call himsef special one, been collect him sack letter on Tuesday. But make una no too cry for am, as I hear say Real Madrid wey be him former club want make him come back. Maybe him dey special afterall.
My pipo we go brake for here. But before I go, make I ask una one aproko kweshun like that:
Aproko Kweshun for Today
One of the Oga wey wan be goffnor for we Las gidi so, Oga Sanwo-olu don talk say Igbo man fit be goffnor for Lagos. Say e dey possible? Na true or na wash? Wetin you think? E fit happen? We don mature reach dat level abi na normal level political washing? I go like know your mind for the matter.
My name still be Maximus Ogheneochuko the pesin wey dey bring una ogbonge tortori yarns for the week. We go see next week, but before then — merry krismass from me and all our MaxOkada pipo dem, to you and your yard pipo.